One Baba wey dey among
the delegates wey camera catch for where dem dey gawk am for the confab wey dey
shelle for Abuja, who be retired police AIG, Baba Hamma Misau don kpef o, for National
Hospital wey dey Abuja.
Baba kpef yesternite
of one kain sickness wey nobody know, the last thing wey we hear about am na d
yeye picture wey dem snap am for where he dey move Naija forward for confab
Na one of him cousin Barrister
Mohammed Hamma confirm for Sahara reporters say the old baba don go rest. Dem suppose
don bury an mow for him village for Bauchi State.

No comments:
Post a Comment