National conference say dem go vex for any media wey deyy
write nonsense against dem and wey tin dem dey do for the conference, and that
vex na to seize the licence wey that person take dey enter the conference. Dem
say na so e dey inside Order 14, Miscellaneous of the National Conference
Procedure Rules 2014, wey dem release for the delegates on Thursday.
The assistant secretary for the conference don first talk am
at dem inaugural meeting say make the delegates dey come report any mis-yarn by
any media house at the Conference Secretariat. But according to Lawyer, Mike
Ozekhome SAN, he say he pray make dis conference no go shoot himself for leg o,
with this hin procedure rules.
Meanwhile delegates for the conference wey come from
South-west do one close door meeting on Sunday nightm dem say na for that
meeting dem wan plan wetin dem go take reply Bros J for him inaugural speech
and the procedure rules wey dem share give dem on Thursday.
No comments:
Post a Comment