The probe wey House of rep dey probe our Oga Madam minister
for Petrol mata, Mrs. Diezani Allison-Madueke on top say she take 10billion
Naira take carry plane for drop don pass anoda apiam way commot o, tory wey dey
commot since weekend na say the house don extend dem probe to the person wey get the jet wey she take do permanent
customer, Challenger 850 Jet.
One member for House of Rep.
Hon. Babatunde Adejare who move
the motion say make dem probe how she take spend 10 Billion Naira on top drop
between 2012 and 2014. Make we no forget say na one association wey dey answer
Concerned Aviation Practitioners na dem take dem money publish advert like 2
weeks ago say one minister wey dem no go mention dey waste government money on top
the jet.
Meanwhile the National Labor Congress (NLC) don salute the
House of Reps as dem dey try shine light for thye matter, but as per Oliver
Twist wey NLC be, na him make dem presido come say make house kukuma do good
finish make dem carry the probe reach dommot of state Governors and other
political office holders wey dey do that kain yeye thing cos according to him
some Governors dey spend like 130million naira on top say dem wan hire and
maintain jet monthly.
No comments:
Post a Comment