Monday, March 24, 2014

IPADABO ABIJA, SAMUEL PETER DON SHOW AGAIN…………………..




Our beta pikin, Samuel Peter, who be former WBC heavy weight champion dey come back o,the second coming of Abija wara, cos he dey fight again on June 4 for wetin dem call Prizefighter-style, Super 8, boxing tournament for Auckland in NewZealand.


According to fightnews, Samuel Peter, alias the Nigerian Nightmare go join Kali Machan, Michael Sprott and Martin Rogan for the 500,000 dollars tournament. This go be the first fight wey Peter who be 33 years old go fight after 3 years, as the bros don loose 4 out of him last 8 fights.

Make we no forget say Oleg Maskev, na him Peter whoz to take collect the WBC title in 2008 but na for hi8m first defence he lost against Vitali klichko, when he try Vitali’s brother again in 2010, that one show am say him wicked pass him brod. Na since dat time bros don rest, but now e be like say he don ginger himself come back.

No comments: