Oga Governor for we Central Bank for Nigeria, CBN, Mrs Sarah Alade, don yarn
say na cashless policy fit do the abracadabra wey go turn naija economy into first class one o, and say the
policy no be to stop the use of physical cash for payment patapata, but na to
reduce the way cash take dey waka for the system.
Alade
yarn yesterday for Ilorin wen CBN dey do sensitisation programme for the
cashless policy. She say the sensitisation programme dey necessary make we pipu
take understand the policy, say we also dey enlarge the financial contact
points make e include areas like post offices, motor parks and corner shops.’’
The
CBN Oga also explain say the policy involved pipu wey get pass N500,000 to take
do business for one day , say pipu wey rural areas plus including other Nigerians
wey no get that kain money to take do business make dem go relax, cos nothing
concern fish with rain coat, the mata no concern dem.

No comments:
Post a Comment