Show me your ID card na wetin dis story
dey ask o as Policemen wey say dem come from Abia State on Friday bombard the house
of Mr. Ebere Wabara wey dey Surulere for Lagos and razzle him commot. Wabara na
The Sun Associate Editor and Special Assistant on Media to Dr. Uzor Orji
Kalu
One statement from the Oga Managing
Director for the newspaper, Mr. Femi Adesina, say na around 6.30 and 7a.m for
where him wife and him small small pikins dem dey na him dem for come carry the
man.
Dem say the policemen wey come na from State
CID, Umuahia, and dem show dem ID to Wabara, and yarn am say some pipu wey dem
no tell am dem name don write petition against am for Abia State. Dem come say
makew he dey follow dem go the state, where dem go for charge am with sedition.
Dem first carry am do excursion for
Lagos from Sholoki Police Station for Aguda, Surulere, den later to Oyingbo
police station, wey dey Lagos too.

No comments:
Post a Comment