Saturday, March 29, 2014

E BE LIKE SAY SOME PIPU STLL DEY INSIDE CAGE FOR SOKA O, AS DEM NEVA SEE THE OKADA MAN WEY CALL



As the mata dey go e be like say some pipu still dey cage for inside the  kidnappers dommot wey dey for Soka, wey dem don sharply change him name to evil forest.


Some pipu wey dey stay for Arowona Adegbeye Estate, Idi-Mangoro, Soka area, wey dey near d place yarn Saturday PUNCH on Friday say e be like say some pipu still dey for inside the place o, wey dem never discover.

For example dem say the okada man who be say na wen dem no see am all dis kasala burst say dem never see am o. Dem say some of the okada man padis wey go the place yarn dem say dem person tell dem say na eight pipu dey where dem dey keep am, wen he halla dem for phone. But till now dem never find am..

No comments: