Come see as better cry for joy dey flow
on Tuesday for Adeoyo State Hospital, Ibadan , where eight of the pipu wey dem
rescue for the Ibadan horror forest dey collect treatment.
The relatives of one of them, Wale
Atoyebi, na him come identify am, dem say na only him name Atoyebi fit talk wen
d Uncle recognize am. The uncle say the boy just commot for house many years
ago, and den know get idea of where he fit dey.
The guy bin dey stay with him paternal
grandmother for Ada wey dey Osun State, but his papa, wey kpef like eight years
ago, bin dey stay for Ibadan. Mr. Atoyebi, who carry him wife follow
body, said even though he dey happy say Wale don show, but him heath dey give
am concern gan.
No comments:
Post a Comment