Na identification carnival e be
yesterday wen plenty families bombard hospital dey find dem pipu wey don lost.
One of them na one woman wey dey cry say her daughter, Nnenka Peters, don dey
miss since 1998.
The mama say the girl papa die for 1997,
and na water d girl go fetch wen dem no take see her again but say e no get how
e be wey she go see her pikin and she no go recognize am. Some of the hospital
workers, wey yarn with newsmen say although some of the victims go eventually
normal, some of dem still dey wey go need psychological evaluation.
Pipu wey represent Oyo State Governor, Sen.
Abiola Ajimobi, also go check we brother, Bayo Faleke of Splash FM, for the
hospital. Na special advicer to the governor on media, Festus Adedayo lead d
representTIVES. Una no go forget say Faleke na him boys wey dey vex hayaj after
them discover the house of horror for Soka area wey dey Ibadan.
No comments:
Post a Comment