No be small mata for Ibadan on Sunday morning o wen boys for
Ibadan carry better cultlass go bombard one hideout of kidnappers wey dem just
discover for Soka Area, wey dey Ibadan, Oyo State and wetin dey dem mind na to
go scatter the building where dem kidnappers for dey hide.
The gist say na one of dem persons wey dem mis-kidnap dodge
halla hom pipu on Saturday evening, dem say na Lanre and denku dem don kidnap
for like 6days, the lanre na okada man and na since last week dem no see him
brake light again, na later later dem come go see him okada for inside Ogunpa
River wey dey thye Soka Area for Lagos/Ibadan express way. But baba god smile
on top the guy as e fit halla him pipu with the phone of another guy wey dem
just kidnap on that Saturday, na him call make him brothers mobilize themselves
say no do, no do dem must free dem brotherman.
Make e no come be like say the kidnappers’ otumapo catch all
of us, na him make we Naija police open a murder investigation on top the
matter as per say even officers follow join for pipu wey rescue plenty pipu wey
those wicked ones don tie for ground with chain and don take better hunger waya
life commot for dem body. The report say wen police searched the abandoned
building , wey dem don give title, House of Horror, na every bad things like
skeleton, skull, dead body na him dem find for floor wey blood don stain. Police megaphone for Oyo State, Olabisi Ilobanafor
,come still gist say na like 7 human being wey dem don gtake hunger turn to
skeleton but wey still never die, dem see for bush wey surround the House of
Horror.
No comments:
Post a Comment