Wednesday, March 26, 2014

NO BE BULL FIGHTING O.......MAD COW HAYAJ AND WOUNDJURE 4 PIPU FOR PORT HARCOURT


This one na bull fighting abi na real life,,,,,,,,,, na FOUR pipu God save for U. D. Filling Station Road area wey dey East-West Road for Port Harcourt wen one cow wey dey craze and just dey escape from him owners hayaj dem.


The animal really cause gobe o, cos pipu wey dey do construction work for the East-West Road gats stop d work first make dem run for their life. One of the victims, Mr. Ogonnaya Okereke, say the cow hayaj dem and take him horn do them serious strong things.

No comments: