Wednesday, March 26, 2014

JUJU OR BADLUCK?........ POLICEMAN SHOOT HIM COLLEAGUE FOR PARTY




Shey dis one na juju abi na badluck, One of the security pipu wey dey follow the  Speaker for Osun State House of Assembly, Idowu, don shoot and kill one of  his colleague, Olubunmi.


Punch correspondent say na on Saturday the mata happened for Ika in Ejigbo Local Government wen Oga speaker go for party, say na night the mata happen wen Oga don go sleep

The story say the security guy still say make he rock body small for the party small after him oga don gawk am but na fight wey he bin wan settle wen some boys dey show demself na him kill am cos some of those thugs attack am.
 
Na him d guy halla him padi wey carry him own gun say make he go rescue olubunmi. As dat one show wey he say make he shoot take create awareness na ontop him padi head d bullet go land, and the guy kpain instantA.

No comments: