Thursday, March 27, 2014

CONFAB OR SLEEPING COMPETITION, NAIJA PIPU DEY PARA!


Pictures wey dey circulate for internet na him make Naija pipu continue to dey ask questions o, whether the plenty money wey we dey pay delegates na for dem to go sleep for the confab.


The Naija pipu wey dey concern say e no make sense o, say na sleep many of the pipu wey suppose go represent dem dey go sleep for the confab instead make dem talk how Naija go take better.   

On top this mata , some pipu don dey talk say ,make dem dey show d conference live as e dey happen on top the website for the confab, cos na so dem fit take monitor the pipu wey go represent dem and make dem take know who and who no dey do well.

No comments: