The
National Conference go settle mata on top how dem go dey vote today, the
conference chairman, Justice Idris Kutigi na him give dis assurance yesterday. He
said him don make up him mind on top dis mata because of the gbege wey dey follow the procedure wey dem draft
say na two-third of d delegates go fit dey make decision.
The
gbege wey first show face on Monday sho him self again yesterday when former
governor for Akwa Ibom State, Obong Victor Attah, beg say make dem dey accept
decision wey two-third majority make. Attah say na so e dey be for other places
where dem for open eye well well say make den just try understand, cos naija no
suppose carry last.
Na
immediately the National Chairman of Labour Party, LP, Barrister Dan
Iwuanyanwu, take him two hands support am, say three quarter go make decision
making a long thing.

No comments:
Post a Comment