Friday, March 28, 2014

DEY EXPECT US FOR YOUR SIDE O, BOKO HARAM YARN AIRFORCE FOR MAKURDI



Security don increase for Nigerian Air Force Tactical Air Command for  Makurdi wey dey Benue State, on top gist wey dem hear say some bad pippu dey plan to attack dem.


Punch correspondent na him hear d gist say the Ogas for NAF don command dem personnel say make dem no gawk am o, make those bad pipu no fit come do dem strong thing, dem say na after dem Fulani pipu and Tiv people for one community  finish dem gbege for back of Air Force Base, wey dey along Gboko Road for Makurdi on Wednesday, na him dem collect letter wey dem boko haram boys send dem say make dem dey wait for dem o.

The story say some Tiv people who dey vex as per say dem lost some of dem personal persons for the kasala wey burst between Fulani herdsmen and farmers go one Fulani pipu camp go warn dem and advice dem make dem disappear from d place.

Dem say na make dat kain thing wey happen on December 2, 2013 wen Boko Haram pipu wake up early momo go attack dem  for the Composite Group of Air Force Base, Maiduguri, and dem fit spoil 5 aircraft.

No comments: