Thursday, March 27, 2014

FAKE CRAZE PIPU DON ENTER AM FOR IBADAN O, NA BURN DEM DEY BURN DEM


If you dey craze no carry am come Ibadan o, cos if your craze see pipu craze e go hide. Na him make say pipu wey dey vex light one mad man with fire on Wednesday and dem roast am till he kpef.


The craze man, according to investigations wey Nigerian Tribune do, na him dem say get hard currency, guns plus several Atm cards for inside him were load, and na wen dem see all these things dem take beating satisfy am before dem light am for fire.

Wen Nigerian Tribune go visit the place where e for happen for Ahmaddiya Crescent, Oke-Ado, Ibadan, where wetin burn remain for the madman body dey, nobody fit talk wetin happened cos police dey fire teargas take chase pipu commot from the place.

No comments: