Friday, March 28, 2014

NA ME KILL PIPU WEY DIE FOR IMMIGRATION RECRUITMENT O!- MORO



Oga MINISTER for Interior, Mr. Abba Moro don talk yesterday  o say he gree say na him dey responsible for like 16 pipu plus including 4 pregnant women wey kpain for the  recent recruitment exercise wey dem arrange for Nigeria Immigration Service, NIS.


The Minister say he still dey pain am gangan and he dey sad say that kain tyin go happen  for the recruitment exercise, wen he dey talk for the public hearing wey Committee on Interior arrange.

But sha o, the Comptroller General of Immigration, CGI, David Paradang yarn say dem wey supposed handle the recruitment exercise, according to wetin law yarn, na serious bone dem bone dem for the mata.

One member of the Board of Civil Defence, Fire, Immigration and Prison Services, Mustapha Zakariya come put petrol for the fire wen he say the signature wey dey on top the agreement where the Interior Ministry and the Board agreed say make dem hire one Consultant, Drezel Technology Nigeria Ltd, say na complete wayo o, cos na forge dem forge am.

No comments: