Shey dis one na mistake ni abi na
signal say make we bone, cos Six months after dem last meeting, members of
National Economic Council, wey be the Oga governors for we 36 states plus
including some ministers,do dem meeting again on Thursday for Presidential
Villa, Abuja.
Dem say d meeting wey Vice Presido
Namadi Sambo coordinate no just talk one thing on top the money wey dey miss from
Federation Account, wey Nigerian National Petroleum Corporation no gree remit.
We no go forget say the missing money
join one of the reasons wey make dem no do dem meeting for like 6 months now
cos d meeting suppose dey shele every month cos say dem bin don hear rumour say
dem wey be members of Governor’s forum wey be Amaechi faction dey plan say dem
go challo Sambo on top d mata. The taafia wey gist us d mata say dem o even show face of the money mata on top dem
meeting agenda.

No comments:
Post a Comment