The Panel wey dey
investigate for the Financial Reporting Council, wey dey probe the financial
accounts of we Central Bank for naija, CBN, between 2011 and 2012, don
press pause for the matter o, as per say one Federal High Court for Lagos don
command say make dem stop the panel.
Oga
Governor for CBN wey dem suspend, Mallam Lamido Sansui na him carry d mata go
court wey he take dey question how presido, Oga Goodluck take remove am and say
make d court yar d panel wey dey investigate am say dem no fit invite am come
show face for dem meeting for now.
The
Council don invite Sanusi plus including the person wey dey form CBN Governor for
now, Dr. (Mrs.) Sarah Alade, the immediate past Deputy Governor, Operations,
Mr. Tunde Lemo, Deputy Governor, Operations, CBN, Dr. Kingsley Moghalu; Deputy
Governor, Corporate Services, CBN, Alhaji Suleiman Barau and the Managing
Director/Chief Executive of Bank of Industry, Mrs. Evelyn Oputu make dem show
face for dem side yesterday come answer question on top d investigation wey dem
dey do into the financial accounts of the CBN for 2011 and 2012.
But
sha o, Sanusi and Alade bone the invitation of the Council. But Lemo,
Barau, Moghalu and Oputu jejely show dem
face and dem try explain some of the mata wey dem ask for the FRC report on top
the 2011 and 2012 accounts.
Na
for morning the panel start dem meeting and wetin dem take start na the donations
wey the bank bin make dose years , the N500 billion real sector intervention
fund, professional fees paid by the CBN, and non- compliance with the
International Financial Reporting Standard, IFRS.

No comments:
Post a Comment