Friday, March 28, 2014

DEY GO HOUSE O, YOU DON MIS DO, NJC SUSPENDS RIVER CJ



This story na according to the gospel of Nigerian Tribune, and the story be say the Oga patapata of Judges for Rivers state, wey dem just appoint, Justice Peter Agumagu, na him dem don tell make he dey go bach home, say dem don suspend am, on Wednesday by the National Judicial Council (NJC) on top say he accept wetin dem call appointment wey do lawful wey Governor Rotimi Amaechi’s dash am.


Dem fit don even start arrangement wey dem go take sack am commot from  office cos the council don give am query say make he explain within 4 days why dem no suppose sack am for mis-do wey e do.

Nigerian Tribune say na on Thursday Justice Agumagu collect him query and suspension letter. Dem delay wetin the council get for mind to take make sure say him collect the letters before dem loud am to the public.

No comments: