Thursday, March 27, 2014

HURRAY OUR CENTRAL BANK DON GET ANOTHER OGA BOSS



Our Senate for naija on Wednesday don give confirmer confirmento to Mr Godwin Emefiele make e be Governor for our Central Bank (CBN), after the man don answer questions from senators for dem meeting wey dem show on tv.


But the man, Emefiele, survived one thing wey for break him heart wen one senator from the opposition Senator Kabiru Gaya (APC Kano), raised one kain point of order say make dem stop the screening.

Gaya yarn d senate say in line with Order 53(5) of them Senate Standing Rules 2011, as amended, them suppose suspended the screening cos d matter dey court.
But dem Oga presido for Senate David Mark, ruled am commot from the order, say the issue before the court na different matter.

No comments: