Governments for Benue and Nasarawa
states don make up dem mind say na air surveillance strategy go make sense pass
to take secure dem kingdom. Governor Umaru Al-Makura of Nasarawa State na him
loud the arrangement on Thursday when he go hail Giza town, wey dey Keana Local
Government Area for the state cos dem attack Giza on Tuesday.
Al-Makura say d thing no make sense at
all and say the pipu who do dat kain tin be criminal wey just use the boundary
dispute take hide do dem criminal tinz. Na there he for come gist dem say the
two state governments don dey work together to do something on top d mata , he
come promise dem say things go soon normal again..
he say government go
continue to dey do him best to guarantee safety of dem lives plus including dem
property, say state government no fit handle the matter alone as e dey be, so
dem don call on federal government make he put hand for the mata.

No comments:
Post a Comment