Wednesday, March 26, 2014

NA AFRICA LEADERS DEY WORRY AFRICA O-AKUFO ADDO



FORMER Vice Presido for ghana who still be global speaker on leadership change, Mr Nana Akufo-Addo say na leadership failure dey make say Africa no dey  too do well inside the comity for continents..


He still talk am say successful leaders na those wey get innovative mind, ability to embrace new ideas and dey always challenge old ones. He dey yarn all dis for the Verdant Zeal 3rd Innovation Leadership Series wey shele for Lagos, yesterday, with theme ‘’Growing Leadership Innovation: Lessons for Africa’’,  Akufo-Addo say we still fit trace many problem for Africa to the hangover of colonialism.

As he dey try find solution to the different kain problems wey dey face us for Africa, the two time Ghanaian vice president explain say African leaders must achieve dem potentials through innovative leadership. 

For him own talk, Shamsudeen Usman say the topic for the event represents excellence, professionalism and Nigeria’s potentials and how to make dem a reality

No comments: