Wednesday, March 26, 2014

BEWARE OF GOLF FOR MAIDUGURI O, BOKO BOYS KPAIN 5 POLICE



Na 3 pipu wey dem suspect say dem go be suicide bombers drive one Volkswagen Golf car go jam one police patrol vehicle wey belong to one police team for Maiduguri, and dem kill five policemen wey dey inside d patrol van and dem injure many other civilians.


Na wen dem see say security checkpoints wey dey for Maiduguri- Bama highway no go gree dem enter Maiduguri town go do dem bad work a him dem jam the police patrol vehicle for near Dalori Housing Estate and dem kill d 5 policemen wey dey there.

Before that one na him Vanguard hear gist say another suicide bomber who dey go Maiduguri from the Sambisa Forest inside another Volkswagen Golf saloon car wey dem load with IEDs, na him go open the bomb around Government Farms, wey take like 20 kilometres far from Maiduguri, and he kill 3 civilians plus d person wey dey inside the car.
 
 The incidents we hear say happen at d same time about 9 am, and he cause serious  wahala  cos everybody for Maiduguri run go hide dem head, and na so parents and guardians dey rush go schools go carry dem pikin, make another bomb for no sound.

No comments: