The Sultan of Sokoto, Alhaji Sa’ad
Abubakar III, on Wednesday carry some
Muslims wey get mouth for this country follow body go see mr president
for the Presidential Villa, Abuja to go do their own royal plus cleric aluta
for wetin dem call marginalisation.
For inside the secret meeting wey dem
follow President Goodluck Jonathan, Vice -President Namadi Sambo plus including
some other few Ogas for government do,
the Sultan and the other muslim leaders say d way dem take compose the
national conference no be am at all, say the mata no do dem well.
Them protest dey shele on d same day wen delegateds for the
conference no still fit agree on wetin go be the majority wen dem wan make
decisions
No comments:
Post a Comment