Saturday, March 29, 2014

IMPOSSICANT, WE NO FIT DIVORCE AFTER 100 YEARS OF MARRIAGE



One former oga commander for Economic Community of West African States Monitoring Group, (ECOMOG) Brig. Gen. John Shagaya (rtd), don yarn Naija pipu o, say make dem no reason am make the country divorce o, after 100 years wey oyinbo pipu don marry us give eachother.


He say na how to take better eye look those things wey dey disturb us and how to take remove dem na him we suppose dey reason. Na for Jos Shagaya dey yarn this mata wen he dey urge pipu wey dey for the National Conference wey dey shele say make dem dey onest, frank, serious and make dem dey purposeful for wetin our country send dem go do.

Shagaya come add join am o, say wetin we need pass for this country na to adjust we constitution, say even the United States of America still adjust him own.

No comments: