Saturday, March 29, 2014

HARVEST OF CRAZE FOR IBADAN, POLICE DON CATCH 10 ALREADY



Police for Oyo State say na harvest dem dey harvest craze pipu now o  cos no do, no do dem don catch 10 of dem wey get hand for the horror film mata wey dem discover for Soka area for Ibadan last Saturday.


The police don first talk am say at least na like 8 pipu wey feature for the horror film na him dem don catch but dem no gree yarn us who dem be and where dem for hayaj dem.

But sha o, d police command say some other craze pipu na him pipu wey dey vex don take vexnation roast o, wen pipu suspect dem say dem craze no be original na form dem dey form am and say e be like say dem too go get role for the horror film wey dey happen for soka.

No comments: