Na
another serious gbege yesterday o cos na like 74 pipu plus including five
policemen, kpain for different mata wey shele for Benue and Borno states, na
him make Governor Gabriel Suswam for Benue State cry out say make military show
face for the mata o, to come help dem check the killings.
Makurdi
hot like fire yesterday wen tory spread say dem don fall like 63 pipu for
Tse-Agena, Mbalom district, Ikpayonge and Adeka market, Oweto in Gwer and
Agatu local government areas by pipu wey dem suspect say dem be Fulani
mercenaries.
Na dis one go follow one wey happen for weekend between Tiv youths and the
suspected Fulani pipu, wey be say na like 55 pipu die for Guma local government
area for the state.
The
member wey dey represent Agatu for State House of Assembly, Mr. Audu Sule yarn
newsmen, yesterday, say na three pipu dem kill for Adeka market on Monday
morning, when those suspected mercenaries bombard the community on dem busy
market day, shooting left, right and center and run commot immediately.
Person
wey see as the thing go woth him koro koro eyes say na around 4am when pipu
still dey sleep and no ready for any kain fight na him den take gun wake dem up,
with the cry of woman and dem pikin wey dey run gidigidi go fin where to hide.
No comments:
Post a Comment