Wednesday, March 26, 2014

CBN BUILDING SING DADDY SHOWKEY SONG...FIRE DEY BURN WALL NO RUN



Fire dey burn wall no run, na that daddy showkey song dey play yesterday for  Tinubu,  Lagos office of the Central Bank of Nigeria, CBN, wen d office catch fire. Dem say the fire start for the third floor of the five storey building, wetin cause the fire na him den never know as of the time wey dem dey write this report.


But sha o some news wey no get leg dey talk say na electrical fault. Den say na about 5.10pm as workers dey move documents and other sensitive items enter the new building. dem say na one waka pass notice d fire come raise alarm say see smoke o, and we all know say there is no smoke without fire
 
Oga director for Lagos State Fire Service, Mr. Rasaq Fadipe, say as dem hear the mata na him dem send two fire trucks from Onikan and Sari Iganmu wey get like 10,000 litres of water each to the place where the fire for dey burn around 5.45pm.

No comments: