Friday, March 28, 2014

AIYE OOOOO!!!! NA 50 BILLION DOLLARS DEM DEY THIEF COMMOT FRO AFRICA EVERY MONTH



This story dey inside Nigerian Tribune dey shout thief, thief catch am, catch am as United Nations burst kasala on Thursday, wen dem loud am say na over $50 billion pipu dey thief commot from Africa every year.  Na the Deputy Secretary General for United Nation, Mr Jan Eliason, loud dis mata when he go hail the Speaker for we House of Representatives, Honourable Aminu Tambuwal.


When d guy dey explain the vexnation on top how pipu take dey thief money for Africa , he say d thing pain person pass wen person realize say dem fit take that kain money do better thing for the continent
 
He say on top say make person dey form peace maker, dey develop economy Naija no dey carry last o, and say we get mouth on top d matter, say the way we take get different pipu for this country dey make sense o an d na him we take be roles models for other countries for Africa

No comments: