Tuesday, July 26, 2016

ON TOP ALBUM MATA: ADEKUNLE GOLD DON CHANGE HAM FOR IM FANS O

Miss Simplicity - Na on di 28th of dis veri month naim Adekunle Gold wey be our ogbonge musician sopoz nack im fans wit him first album wey he call di name 'Gold' o bt d guy just decide to change ham for evribody di way WizKid bin change ham for pipu for 2014 wen im nack dem him album 'Ayo' for iTunes before di date wey he tok sey him go release ham o...
Oga Adekunle sef don sama im fans wit im new album for iTunes yestaday instead of on di 28th o..
Na only Simi naim Adekunle Gold feature for di album wey get 16-track nd sum of di song for di album, na Simi mix ham o...
Yes o I dey see tins on top dat level bt I go just dey here dey observe o...meanwhile make all of us go listen to di song dem for iTunes o, make we no fall oga Kunle hand o...

No comments: