Wednesday, July 27, 2016

(FOTO)CONGRATULOBIA!!! AISHA SALMA DON MARRI OOOO

Miss Simplicity - On top famili mata, Aisha Salma wey bin dey date one naija guy nd wey bin introduce d guy give her papa nd mama for 2014 nd wey be Miss Uganda before before naim don readi to start her own famili o..
Di lady wey bin black nd wey bin win 2003/2004 Miss Uganda title naim don marri her handsome old lover wey be white man for Miami wey dey Florida o....
Ma'am Aisha sef com confirm ham sey she bleach her body wen she tok sey na she get her body o nd na anytin wey she like naim she go do for her skin o nd sey na her right oooo...
Yes o we know sey pipu go don dey throway salute nack her since d marriage bt make e for no lost, we for TPN too dey sey congratulobia to di two pipu wey dey start their famili so o..
See d wedding pinshures afta di cut....

No comments: