Miss Simplicity - Ivie Okujaye wey marry her husband Ezie Egbo on Friday April 17, 2015 nd wey welcome their girl pikin on Friday wey be July 1, 2016 naim don do sum tin wey wonderment many pipu o, sumtin wey e be sey oda celebrity wey born pikin like her no do o, Ivie don show her fans her pikin face oooo, she no do like oda celebrity wey dey kip their pikin until wey d pikin big small o, Ivie cut rope, she post on top IG say she don plan to enjoy motherhood o...
Yes oo, I no go lie una me like dis kind package, ma'am Ivie u too much nd once again o we for TPN dey tok sey congratulobia to u nd oga Ezie...
Make una see d pikin fine pinshure afta d cut..
Wednesday, July 6, 2016
(FOTO)SEE WETIN IVIE OKUJAYE DO WE MAKE PIPU TOK SEY SHE TOO MUCH...
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment