Monday, May 30, 2016

NICE ONE... SOLDIERS CATCH SOME BAD GUYS WEY BE MEMBER FOR NIGER DELTA AVENGERS

As Federal Government dey hustle to stop the gbege wey dey shele to  oil and gas pipu for Niger Delta area, we Army for Naija don catch  10 pipu wey dem suspect say dem be part for Niger Delta Avengers. Tori yarn us say na around 1:40am on Saturday dem catch dem for  Oporaza community, Warri South-West Local Government Area for Delta State, when dem go torch light the area. Some oil company for the region na him dem don scatter and na dem dey make oil and gas production for we country dey be one kain. The Oga Commander for the 4 Brigade, Brigadier-General Farouk Yahaya, wey show the suspect face on Sunday for Benin, say na since January 1, 2016 dem don dey show dem self say dem wan force Naija close shop for where we dey see oil. He come still yarn us the plenty things wey dem see collect from the hand of the badt guys na 28 detonator cords (wey dem still dey call Detonator 33), one pistol, two pistols, 196 rounds of 7.62 special ammunition, one round of nine-millimetre ammunition, one live cartridge plus including 5 daggers. Dem still collect, 15  radio, 18 phones, 203 SIM cards wey be for 3 major network, 5 swimsuits, 2 headlamps, one laptop, 2 ipads plus one camera.
Dem still collect 7 wraps of Igbo, 5 speedboat throttle cables, 6 pairs of hand gloves and like dat like Dat. Abeg catch dem o, COS we no get light.

No comments: