Adeniyi nd Toyin Aimakhu separate for 2015 afta 2yrs of their marriage base on sey dem tok sey Toyin o catch ham wit one of her staff o....
D tin dey painful sha but pipu no still comot mouth for d mata o nd bcos of dat Adeniyi don enta Instagram com tok sey abeg o make pipu leave ham alone o nd make dem no dey use all d time take dey remember ham sey him nd Toyin marriage no last o. He tok sey him no tok abt him marriage for reason wey dey best known to ham o nd bcos him no want pipu opinion o. He tok sey make dem comment for him pinshures nd posts o bt sha make dem leave him past marriage nd life from their comment o as many comments na to destroy no be to help o. But na wa o, I no see y pipu go dey hold on to oda pipu past o. Dis tin don past abeg o, make una free Adeniyi, Toy in sef don move on wit her life, I dey tire for sum pipu o...Oghene Biko oooo See d pinshure wey him post nd pipu comments afta the cut
No comments:
Post a Comment