Nawa.... E Neva reach 3months wey NBC say make radio no play Olamide song again, that one na Bobo. Dem don talk am again O, say make radios for Naija ni play anoda Olamide song again O., dis time na song wey still dey hot wey me sef like die. The song na Don't Stop. Many stations like the song and dem dey jam am well well, but anybody wey play am again go chop fine.
Dem talk wetin make dem ban the song sha, dem say Badoo talk some kain things wey no good for Radio. Some of the things wey dem say he yarn na “I just wanna hit it now now now,” “Je kin wo be ( meaning: Make I enter the place),” “don’t stop, take it,” “Oun tami oun ro mi,” “It took your mama 9 months to make it,” “wa gba ponron ( meaning: come make I give you p*nis )
No comments:
Post a Comment