Miss Simplicity - Yes o as e be so, d tori wey dey nack our doormot naim dey tok sey Omoni Oboli wey be actress, filmmaker nd mama of three pikin naim don win award wen dem dey do Nollywood Week for Paris, France o.D award wey dem give her to take add join d ones wey she bin don collect full ground naim dem call "Audience Choice Award" o nd d actress don win price wey she go take use Angenieux lenses take shoot any film wey she wan do again...
D actress no wan cover Baba God gift for house naim make her com on top her instagram com tell her fans d news gift wey Baba God give her o. She thank God for Him mercy nd she pray sey o make He dey sama her wit correct correct blessing o nd she com still sama us wit d pinshure wey she take wit d "Prix du public" award wey dem give her o Correct, all dis kind tori dey totori my body base on sey e dey show sey e still get wetin oyinbo pipu like for naija.. Na so, we for TPN dey sey congratulobia ma'am Omoni nd we dey pray sey na beta beta tins naim Baba God go dey do for u, ur family, us, our family nd friends oooo....
No comments:
Post a Comment