Miss Simplicity - Lil Kesh wey bin dey unda YBNL label naim don com out com clear pipu mind on top d issue sey him bin run leave Olamide afta d guy don help ham up o. Lil Kesh wey come Metro9.77 FM program wey d name be "The Drop Spot' tok sey even tho him two yrs contact wit YBNL end for March, him no just kawasaka comot dia o bt sey na Olamide himself naim advice ham sey make him go open him own label afta d contact end make he too for fit help oda guys wey dey street o. Lil Kesh com still tok sey him label wey be Y.A.G.I sef dey enta YBNL Nation o, sey d two labels na brodas o base on sey na Olamide build dem o.. Hmmm so na so d mata be? Lil Kesh e gud as u shed more light on dis mata o bcos pipu bin don feel sey u no dey grateful before o, Na beta advice naim Olamide give u sef....so make u carry waka, Baba God dey ur side.

No comments:
Post a Comment