Friday, June 3, 2016

UNA YEYE COMMENT NO FIT SPOIL MY HAPPINESS O....MZZNAKI TETTEH



Miss Simplicity -Mzznaki Tetteh wey be Ghanaian bride-to-be wey her pre-wedding pinshures collect many many gud nd bad comment naim don com out com tok sey she still dey confident o, sey d yeye yeye comment wey pipu give for her pre-wedding pinshures abt her weight no affect her o bt she tok sey she thank pipu wey tok beta tin nd wey compliment her o. Mzznaki wey she dey tok make pipu knw sey na nurse wey love fashion wella o nd she na achiever nd she no go let pipu tok o com make her loose her self confidence o. Her fiance, Prince Kojo Amoah for one interview tok sey him dey proud of him woman o nd him no care abt wetin pipu tok o... Like I tok wen I post her pre-wedding pinshures, e no easy for fat pipu to get self confidence o bt dis lady get ham yanfu yanfu, she no send at all. Naim make me o from TPN stable dey tok sey d wedding wey dem wan do for June 25th so, God go make dat day stand wella nd d marriage go sweet pas honey oooo.
See d pinshures afta d cut, her comment for instagram nd d new pinshure wey she sama us....



No comments: