Monday, April 11, 2016

CONGRATULOBIA... SEE THE BETA AWARD WEY CITY PIPU SAMA ADEBAYO FALEKE

One of the radio person wey get fans pass for Ibadan don still put anoda feather join him camp as City People Entertainment don sama am one beta award wey dem call award for 'Fast Rising Broadcaster and the Rave of the Moment'. Na so Bayo O... take climb him facebook go hail God, Jehova El-lohim and him fans for Naija and for obodo Oyinbo say na dem O. We for TPN say congratulobia to kakaaki Eledumare.

No comments: