Friday, June 3, 2016

(FOTO)SEE LEVELZZZ AS OLUBADAN WELCOME FUNMI AWELEWA FOR HIM PALACE....



Miss Simplicity - Funmi Awelewa na one correct actress wey Nollywood get nd she like culture wella. Na bcos of her love for culture naim make her dey Ibadan land now dey shoot one film wey she call d name "Omo Ibadan" film wey be e go put Ibadan wey be ancient West African city for spotlight o. Wen Olubadan hear d film tori, he come invite Awelewa com him palace  yestaday o wey be d 2nd day of June 2016 nd d actress honor d invitation wey she come wit T-shirt wey dem write Omo Ibadan for d back o. Oba Saliu Akanmu Olasupo Adetunji (Aje Ogungunniso1) wey be His imperial Majesty naim tok sey him like d concept wey Awelewa bring come o nd sey d concept go uplift Ibadan o nd on top dat mata, he com bless Awelewa nd he tok sey him go support d lady o....
See levelzzz, d way Awelewa wey we knw as Morili take dey smile for d pinshures dem, e show sey she enjoy herself for d palace yestaday oooo. Make we see more pinshures afta d cut oooo....



No comments: