Police for Ogun State don start to dey find one vigilante guy, Oluwaseun Olusanya, sake of say he kpain him padi, Adeniyi Shokoya, for Oru Ijebu area. Tori yarn us say Olusanya and Shokoya get gbege on top N100 wey dem collect from one person. Na so Olusanya push 38-year-old Shokoya, na so dat one do like dem prayer point for MFM, he just fall down and die. We hear say on Monday, May 30, around dat kain 4pm, the 2 of dem go Ile Oba area for Oru Ijebu, go do vigilante meeting. Na for the meeting, Shokoya wan talk about the gbege wey the N100M don dey cause, but dem vigilante chairmo no gree make he talk him mind. We hear say afta the meeting, Shokoya go meet him Padi say why he go wan fall him hand, talk Dat kain thing for the meeting. Na so dem start to dey shout for each other, wey one push the other wey come carry head go nack something and dem rush am go hospital where dem conform am for dem say the guy don cross the Jordan. Na sharperly dem go report the mata for Tapon Police Division, Ijebu Igbo, and dem later transfer am to the Area Command for Igbeba, Ijebu Ode. One of Shokoya family member say wetin kill am be say other vigilante no quick answer am sake of say dem dey side the person wey kpain dem brodaly.

No comments:
Post a Comment