Ekiti State Governor, Mr Ayodele Fayose, don carry gboa give Sai Baba as he gree to follow the Niger Delta militants yarn, especially the Niger Delta Avengers and say make dem stop military gbege for the area. The governor say Federal Government gats to show say dem serious so the militants go fit trust dem and the process. He say presido gats to sabi say democracy na about negotiation and concession. For one statement wey dem sama up live by Special Assistant on Public Communication and New Media, Lere Olayinka, the governor say na Niger Delta still dey give us money wey we dey spend for Naija and na dem money others dey spend and e no go make sense make dem come dey do war film for inside we kitchen. Fayose don first advice presido last week on Thursday, say make he follow dem yarn. He say how we presido dey address the mata no be so, make he stop to dey use strong head where dem suppose just yarn. He say na agidi wey Presido dey do don make us loose billions of dollars for Naija.

No comments:
Post a Comment