Soldiers for Naija don warn cultists for Rivers State make dem drop dem weapon and stop to dey kpain pipu for the state and make dem ready to follow dem drag sututu wey go do dem like war film. The Assistant Director, Army Public Relations, 2 Brigade Nigerian Army, Port Harcourt, Captain Eli Lazarus, na him polongo the warning on Tuesday, when he say soldiers no go gree for dem again as dem dey fall innocent people, including the security pipu. Na for time wey no too tey some cult groups for Rivers State go Waylaid 2 communities for Emohua and Ikwerre Local Government Areas, where dem for kpain plenty pipu plus pafuka one full police station. Lazarus for the statement on Tuesday, say apart from say dem no go allow Dat kain thing happen again, dem go make sure say pipu wey don the one wey don pass sef go collect dem punishment wella.

No comments:
Post a Comment