The National Oga for APC, Asiwaju Bola Tinubu, don say na lie be the rumour wey dey waka say him the yab wetin President Muhammadu Buhari dey do for office. Tinubu say him and the presido no get any kain gbege at all. For one statement wey he throway on Tuesday by him megaphone, Sunday Dare, yarn say wetin dem say Jagaban talk where he for dey yab Sai Baba government na big lie O. Dare say na more than 80 pipu halla am for weekend on top the mata. He say na one of the things wey social media dey cause be dat and na pipu wey wan scatter the relationship between President Buhari and Asiwaju Tinubu dey arrange dat kain level and he sure am die say dem don fail. Already, they have failed. He say Sam Omatseye, wey be chairmo for editorial board of The Nation, na journalist wey sabi and he get him own mind. He don dey run him weekly Monday column since dem start the paper and he no fit speak for Asiwaju Tinubu. Wetin he write on Monday 30th May wey he title 'When the bell rings twice' na him own mind wey he write and he sign for himself by himself. So why pipu go dey talk say na Asiwaju write wetin he no Sabi anything about.

No comments:
Post a Comment