Friday, June 3, 2016

SHUU... POLICE CAUSE ACCIDENT FOR LAGOS, TAKE TEAR GAS RUN AWAY

Kasala burst for tollgate area for Ikeja, Lagos State, on Thursday after 2 policemen, go cause one kain small accident, come still thro tear gas for pipu wey dey waka for the road, one of the pipu Taiwo Folarin, try write down the names of the officers, as e dey happen.
PUNCH Metro yarn us say the policemen, wey nobody sabi tear race commot for the area. Folarin, when yarn with press pipu afta the gbege say he dey drive to him office for Lagos Island when the driver for one LT bus just stop for road. He say na manage him manage press brake, but person wey dey behind am just jam am from back and he run away. He say na so him pursue dem cos dem don move and when he reach there as he dey explain give dem say shey dem wan kill am ni, sake of say na 2 policemen dey inside the bus with the driver. He say one of dem just come down and carry tear gas baff him face. Folarin, say he want make police shine light on top the mata O sake of say he manage get dem plate number wey be LND 423 XA, but he no fit get dem name,  but he Sabi dem if he see dem. Dem say don report the mata for Alausa Police Division. Police megaphone for Lagos, SP Dolapo Badmos, say dem don dey shine light on top the mata.

No comments: