Friday, June 3, 2016

WOMAN WEY CCTV CATCH SAY SHE WAN TAKE THE 2 PIKINS DO TWINS NI

One suspect, Zainab Salisu, wey form like say she be customer come go kidnap one 1 year old girl, Fehintola Lawal, for the Abule Egba area for Lagos State say she don give the girl anoda name and the name na , Taiwo, plus another  boy wey dem kidnap, Kehinde come change dem to illegal twins.  Salisu wey be 42 years old na from Daura, Katsina State, yarn PUNCH Metro on Thursday say she lie give her husband, say she dey travel commot from Naija in 2015, sake of say she don get Belle and she wan go born two twins. Tori yarn us say the woman go meet Damilola Lawal, wey be mama of the pikin wey she carry, for one shop for Abule Egba area come go ask for some things wey dem no get. 2 days later, Salisu and the pikin mama say make dem go buy the things for Agege area. Na so she take kolobi Okada, wey she carry Fehintola, wey dey her back run. Na on Thursday policemen from Anti-Human trafficking Section for the State Department of Criminal Investigation, Yaba, on Wednesday for the Idimu area of the state. Fehintola plus anoda one-year-old boy na him dem save   from Salisu house wey dey on top Koleade Street, Council bus stop for Idimu. When she dey yarn for Lagos State Police Command Headquarters, Ikeja, Salisu say she carry dem sake of say her husband dey house dey wait for her make she carry twins come.

No comments: