Legal Adviser for International Secretariat of Amnesty International, London, Mr. Kolawole Olaniyan, don say e no make sense as Baba Obasanjo, wey be we presido before for Naija dey yab Justice Mohammed Idris of one Federal High Court for Lagos. Tori yarn us say don describe the judge as person wey no sabi anything come still mumu join sake of one judgement wey he deliver say make every presido under democracy for Naija from 1999 to 2015 come talk wetin dem sabi on top money wey dem see collect from military dictator, Gen. Sani Apache wey don kawasaka. The judge yarn dat one when he dey siddon in top one mata wey dem carry come him court by the Socio-Economic Rights and Accountability Project, say make dem polongo, make everybody sabi the koko of the money wey dem don see collect from Abacha money and how dem take spend am. The judge don give one kain command, say make Federal Government, pass the office of the the Attorney General of we country, say make dem force government of Obasanjo; government of Umaru Yar' Adura wey don kpain; plus dat of former President Goodluck Jonathan make dem polongo how far dem don go on top the Abacha money mata. Tori say Obasanjo, say na which kain mumu talk be dat one? He say person wey ask and person wey answer am, all of dem na good, with die respect ni O.

No comments:
Post a Comment