Thursday, June 16, 2016

SHUU.. EFCC WAN TAKE QUESTION FINISH SHERIF LIFE ON TOP ELECTION MONEY

No be small gbege O. When EFCC on Wednesday wan take questions kill, person wey dey fight for PDP Chairmo, Ali Modu Sheriff, from 10am to around Dat kain 5.30pm. Tori yarn us say na for dem office wey dey Maiduguri, dem for gbege am on top wetin he do when dem dey share $115m (N23bn) wey come from one former Minister of Petroleum Resources, Diezani Alison-Madueke ., when dem dey prepare for presidential election, sake of say dem hear say na N450m dem bin send go Borno State and na the before Minister for Power, Mohammed Wakil.  Dem cone say na N40m dem roger Sheriff through Alhaji Mohammed Kumaila, one PDP chiefo for the state. One confirm tatafo for inside EFCC say Sheriff, wey be Governor before for Borno State, na him dem come free am on top wetin dem dey call administrative bail say make he show back for anoda time.

No comments: