
Tuesday, September 22, 2015
AJIGIJAGA WIFE BORN BOY, 46 DAYS AFTER BROKEN BOTTLE KPAIN
I don even confuse as i no know maybe na eeyah persin go talk ni abi na congratulobia. 46 days after we big bros, Mufutau Sanni a.k.a. Ajigijaga wey dey do thug for inside yoruba film kpain. Him 26 years old wife wey he marry 2012 don born boy on monday 14th September and na yesterday dem name the pikin. No be say he no get wife and pikin before o, but tori yarn us say Ajigi say him no marry dat woman legally. Dem give the pikin Babatunde, some dey call am Ajigijaga, but make we call am Unbroken Bottle. May Baba God sama am longer life and prosperity.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment